NewStats: 3,263,654 , 8,180,912 topics. Date: Saturday, 07 June 2025 at 05:10 AM 1o4g19

6z3e3g

MiztaPepperoni's Posts 3q2w4f

MiztaPepperoni's Posts

(5) (6) (of 6 pages)

MiztaPepperoni(m): 9:51pm On May 07, 2021
Abeg make una no dey deceive person with all these estimations. Even 50k no go start the business well. The road side you no go build shade or na for under sun people go dey chop? That's if you no go arrange shop ooo.
Na for one small bench customers go sit-down dey chop? If the roadside no be front of your house you think say you go just go anywhere put shop begin dey sell? Every space get owner either private or government and you must dey pay small thing.
Then think of the stress to dey carry your things to and fro everyday, because you no go leave them for road side. The matter look simple and cheap but e hard oooo. Just budget like at least 200k to start small if no be for your house you wan start am.

4 Likes 1 Share

MiztaPepperoni(m): 9:36pm On May 07, 2021
Officialgarri:
This one was defeated in the Senate and gubernatorial ambition before delving into a failed Nolywood career.

Talk of failure, you can't miss out the name Dino Melaye

E be like say you don craze or you sell your brain. No vex ooo, your father don senate gate before not to talk about make him get office for there still dey chop pension? You call ex senator failure wey still get national cake benefit till him die.

4 Likes

MiztaPepperoni(m): 9:30pm On May 07, 2021
Abeg make una no vex ooo, I just wan reason with una small.

With the present situation of things for naija, why all these big big prophet dey quiet?

If elections wan reach them they get prophecy anyhow, but as yawa dey e come be like say their God no come dey show them anything again.

All of them be like say them use style relocate from naija or maybe them just park on low-key so I no understand.

Abeg them no fit come together fire all those prayers wey dey heal the sick and all make e take help us heal our country?

I really no understanding oooo
MiztaPepperoni(m): 7:25pm On May 07, 2021
BKayy:
No casualty on the side of Nigerian Armed forces?
Mr Army media please explain this picture?
Its all over twitter from eye witnesses

Bro no vex ooo i just wan know if you understand the meaning of casualties. Because the small school wey I go, I no if car wey burn the meaning of casualty sha. Maybe you fit enlighten me oooo, Abeg no vex.

4 Likes

MiztaPepperoni(m): 12:13pm On May 07, 2021
Psalmspsalms:

Na only her legs u fit see, abi

Leave that guy, na leg him wan look take marry wife. Maybe na him wife leg go dey help maintain the home.
MiztaPepperoni(m): 11:06am On May 07, 2021
But this op no really get sense ooo. So them be students with weapons, juju and stolen vehicles abi

1 Like 1 Share

MiztaPepperoni(m): 9:19am On May 07, 2021
pyyxxaro:
It won’t stop devil from using her after the wedding

This comment wan choke me lol

1 Like

MiztaPepperoni(m): 7:55am On May 07, 2021
I came across this pictures on facebook so I come dey wonder if this na true love abi na true madness.

This na security man wey just cause traffic because him wan propose to him girlfriend for middle of road.

1 Like

MiztaPepperoni(m): 2:27pm On May 06, 2021
We see and hear different painful news about the security issues going on in Nigeria every single day. Though I am not in of the soft hand being used to tackle these issues by the presidency, I think it's high time we all encourage our security agents across Nigeria and give them maximum and moral to do a great job instead of fighting, killing and insulting them everytime.

We can see that many of our security agents are putting their best into their jobs aside some few bad eggs among them that contribute to money harm than good. Let us boldly encourage them, put them in high spirits and show them more love than hate and I believe things will gradually get better.

If you agree with me you can share this message as far and wide as possible. Let's show them some love.
MiztaPepperoni(m): 5:15pm On Apr 07, 2021
A 46 years old sexy lady chatting with her 18 year old sugar boy she just knew online some hours ago.

SUGARMUM: I'm so Hot right now , wouldn't you like to eat my ass someday?

BOY: Damn yeah I would like that, by the way send me a picture of your ass ,if you don't mind babe.

She sends a half naked picture without a face on it

BOY: Damn that's so huge, I just can't wait to penetrate into it.

SUGARMUM: Me too baby, by the way I will talk to you later I think my husband is back because i can hear the sound of his car at the gate.

BOY: ooh okay bye I also think my dad is back because I'm hearing his car.

SUGARMUM: Wait a minute, where exactly do you stay in Abuja?

BOY: I stay in Haruna street, sun city estate, house number 75.

SUGARMUM: Kevin is that you?

BOY: Mum is that your ass?

Abeg make una enjoy una day Jare.
MiztaPepperoni(m): 11:24am On Apr 07, 2021
Imagine say you just discovered your girlfriend dey cheat on you with one sugar daddy. You confronted her about it and she started making up excuses and then she form vex pack her stuffs from your house. Unfortunately for her she forget to check the bathroom to see her two pants wey she leave for there.

Abeg my people, after everything wey you don invest for this girl, wethin you go use the pant do?

Person say him go sell am to yahoo boys. Another person say him go carry am go where soldier ant dey build their mud bury am there make the ants chop am so that she no go fit born again. One person come say him go call her come carry her yeye pants.

If na you wethin you go do?

1 Like

MiztaPepperoni(m): 1:01pm On Apr 03, 2021
On a very cool Sunday evening while relaxing in my Lagos Island apartment enjoying the cool Ocean View with some friends, I suddenly got a call for an urgent business meeting in Abuja for Tuesday morning. I had to put my stuffs together and booked a flight for Monday with a special top notch hotel already reserved for me around Asokoro area.

Monday I freshened up nicely as usual and dripping all Gucci from head to toe. I headed to the airport and at the right time I bordered my flight. Seated next to me was a beautiful classy looking corper also heading to Abuja and she kept giving me this cute sexy smile so I had to initiate a good conversation with her and we flowed so well.

Getting to Abuja we exchanged numbers and I told her I will invite her over to my hotel that evening so she could keep me company and she was so excited about it and promised to come whenever I request so we hugged and went our separate ways. I was feeling super fly because I knew I had a confirmed kpomo to devour that night and I won't be lonely through out my stay in Abuja.

Later that evening she showed up looking all sexy as hell and immediately she entered my suite she grabbed me into a very hot kiss that blew my brains out. Just like that it got really intense and was leading to getting down but as a gentleman man I had to put the moment on hold.

She understood everything and felt shy like someone who probably havent made love in a very long while. So we decided to order some food and champagne to spice up the evening before we properly get down to business. Few minutes later the food was brought and the chicken was looking so yummy yummy my mouth felt watery. I open the champagne and I made a very romantic toast that swept her off her feet and just as I was about to pounce on that spicy chicken and chips, I heard a very very loud knock on the door and it sounded like thunder. As I shouted JESUS and ran to open the door, na then my eyes clear when I see my guy stand with garri and groundnut dey shout for me say "guy see our garri and groundnut wey you say make we chop. I dey wake you since you dey lick mouth for sleep"

Chaiiiiii I nearly faint when I realize say I still dey my face me and face you room for Agege. Wethin my guy do me pain me wella because as we never see chicken chop for years and kpomo to devour, him for just allow me enjoy am for my dream before him come wake me.

Abeg make una enjoy una Easter Jare.

8 Likes

MiztaPepperoni(m): 2:00pm On Apr 02, 2021
Some people dey mumu anyhow sha.

MiztaPepperoni(m): 6:43am On Mar 20, 2021
This one burst my head ooo
MiztaPepperoni(m): 6:40am On Mar 20, 2021
I trust Wike.

1 Like

MiztaPepperoni(m): 1:00pm On Mar 18, 2021
I always use to hear people saying there are many sugar mummies around Lagos. When me and my guy dey go find small ogogoro t make we high, na so we dey see some young guys dey us with fine fine machines. I go dey wonder how e happen before I come hear say some na yahoo and some na sugar mummy doing.

Anytime I am lying down on my mattress we don nearly flat reach the floor itself, I go dey look my ceiling dey wonder, why me self no go drive Benz or Venza. I dey reason to try yahoo but I come say EFCC ati carry go lock for cell and I no fit go die for cell. I reason sugar mummy but I hear say if suger mummy catch you with another babe that is ati cut off your brokus.

I sha crossed my mind and decided to package small and go for sugar mummy option. So one day I wanted to go somewhere but I didn't have enough money for transport so I decided to trek small under hot sun so that I cut the distance before I enter bus. Due to the hot sun I come say make I stop buy cold pure water drink before the sun roast my brain. Omo na so one better Venza just come park near me ooo, the person wind glass down I come see one find kpokish looking chubby yellow sisi inside the machine. Chai for my mind I say na so God take bless me with my own sugar mummy so. I don dey do thanksgiving inside my mind dey imagine so las las na me go come dey push this Venza cruise town.

The next thing I hear the lady talk be say make I no dey offended, say she just misplaced her purse abi na handbag I no know but sha say all her money, ATM card and bla bla bla don go. Now wethin burst my head be say she say she need small money like 3k to buy fuel for her Venza say make I no worry she go collect my number so that when she reach island side her bank she go call me send me the money back with small interest.

My people I just look the woman dey speechless, until she say why I no talk anything I come get myself back come tell her were I dey trek from and were I dey go wey make me decide to drink water. I tell her say as I dey so na only N100 remain for all my financial status both home and abroad. Na so the lady just hiss zoom off ooo.

But wethin I no understand na say we sure say the lady no be professional yahoo so? Imagine say that woman package about 10 people 3-5k omo she don hammer that day ooo. Na that day I come reason say all man with him owe hustle for this life ooo. At least sha she no thief na who fall she go chop.

Ya all have a great day yo.

14 Likes 1 Share

MiztaPepperoni(m): 11:12am On Mar 18, 2021
See how time flies. See how this little superstar comedian has transformed over the years as she becomes a woman.

MiztaPepperoni(m): 7:59pm On Mar 17, 2021
It was a beautiful Friday morning and I had a contract I had just completed and was to confirm a cheque with a huge amount of money in the bank that morning.

Feeling all paparazzi, I took my bath and dressed up all fresh to the bones. Had breakfast, picked up my car keys and headed outside into my already perfectly washed black Mercedes Benz G wagon and off I am to the bank.

Playing some very cool morning blues and ing through the beautiful Victoria Island in Lagos, I got to the bank and handed towards the counter but being a usual Friday the bank hall was quite full. Being the gentleman that I am I had to the queue and wait for my turn. Few minutes later some guy offered me his sit as he had to rush somewhere and just beside me was this very beautiful damzel that seemed to have just fallen from heaven mistakenly.

I was like WOW... What an epitome of beauty to behold and I initiated a conversation which began to flow so well. I guess the freshness hovering all around me was like a magnet to her that she couldn't hold on to herself. Swinging my G wagon car keys with my legs crossed to the sight of my expensive Gucci shoes and the sweet scent of heavenliness from my Cologne, the damzel pushed herself closer to me and I threw my left hand over her sit for her to rest her head on my muscular arms.

Lo and behold the next that I noticed was that she brought her so so sexy lips very close to my face, touched my face so softly not even minding the people around us, smiled so charmingly and boom, my lips grabbed hers like two magnets placed very close to each other.

My people, the next thing I felt was something like a thunder strike and it felt so painful on my right cheek and immediately my eyes opened all I could see was so many stars in the sky before it cleared off and I shouted JESUS..... I saw my roommate standing in front of me as I laid on our mattress in our face me I face you room in Agege. He said, guy e be like say you don dey mad ni. Na me you dey hold wan dey kiss abi.

Na that time my eye clear well say everything na dream. Abeg make una no vex. Them say if you dream am, you go achieve am.

Have a lovely day.

13 Likes 1 Share

MiztaPepperoni(m): 2:19pm On Feb 25, 2021
Tony is a bachelor who likes to drink and enjoy life especially during weekends when he isn't working. He doesn't have a girlfriend because he claims he doesn't want girlfriend wahala so he prefers meeting girls that just want to have fun, sex and be paid cash with nothing attached.

So on this very day he went for his usual enjoyment and after everything he took a call girl home to cure knoji and unfortunately he was so drunk he liked the sex with the girl to the point of forgetting to use a condom again. The next day he went to the same bar to pick the same girl and still had sex with her without condom then later he dropped her off and they never met again since then.

Nine months later, from no where this lady just brought a baby to Tony and said he is the father of the baby. For full nine months she never mentioned she was pregnant neither did she and Tony see all through only for her to just come to his house unannounced saying she was just coming from the hospital were she just gave birth.

My brothers in the house, if you were in Tony's shoes what will you do?

(5) (6) (of 6 pages)

(Go Up)

Sections: How To . 55
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or s on Nairaland.