NewStats: 3,263,015 , 8,178,835 topics. Date: Wednesday, 04 June 2025 at 11:39 AM 3r6b4y

6z3e3g

MiztaPepperoni's Posts 3q2w4f

MiztaPepperoni's Posts

(1) (6) (of 6 pages)

MiztaPepperoni(m): 8:36am On Aug 23, 2021
I no see even one dozen

2 Likes

MiztaPepperoni(m): 11:36am On Aug 21, 2021
People think say naija dey craze and them dey find visa go some kind countries like this same country.

Our craze na small thing where some foreign country craze dey. Especially when people dey hype USA as heaven I dey laugh because na only their imaginations. Make them go watch crime scene investigation or FBI profile see wethin people dey do. Them go understand say even boko haram and bandits dey learn work

1 Like

MiztaPepperoni(m): 11:29am On Aug 21, 2021
Starz825:

Bros...a guy wey no dey last na problem oo for their woman...
Money is not everything oo..
Good sex is priority too on it own

My guy sex no be everything. If you dey with a career woman you go understand say sex no be everything as long as say you self dey hustle well.

See these hard core sex na once in a while thing when una as couple get free time to have so much fun and sexual adventures.

To dey carry that sex things for head na error. Early morning sex na the best and that no dey last. So you want tell me say two people wey get career go dey reason hard core sex in the morning or night.

If e give the man chance on him free days and show am wethin she like las las na she go begin complain.

But make I ask, wethin be the joy of nacking after both of una don dey satisfied? Shey una go need to chop well and even talk about important things to make the relationship grow. Abi na just to satisfy una self sexually be why una dey the relationship.

Shey Tonto say her former husband na one minute man and she leave am dey form acapon, now the one minute man she talk another woman cherish am. This life no be sex matter. If e sweet for one minute, dey enjoy that sweet one minute everyday when you need am than to dey fine one hour wey go kill you
MiztaPepperoni(m): 9:52am On Aug 21, 2021
All these foolish women wey no get focus for life. Na sex be your priority for life? Man dey try hustle make him woman dey okay and the woman problem na lasting in bed. Na the guy I dey sorry for, wey no know say him dey follow no future ambition girl wey her own na sex.

Na even boyfriend, no be husband. Make I bend if una marry las las. While you dey find man wey no get future just dey focus on how to satisfy you, this guy go still find better woman wey sex no be her problem and them go dey happy.

Yeye girls just full everywhere. Sex sex sex without brains
MiztaPepperoni(m): 9:22am On Aug 21, 2021
Na God make us nice no be our fault.
MiztaPepperoni(m): 1:34pm On Aug 20, 2021
As I see this news, I check if e make price of groundnut oil go down but shi shi no change.

I dey try use sand fry my beans like groundnut.

1 Like

MiztaPepperoni(m): 10:57am On Aug 19, 2021
Many of una for this Nigeria no just get sense. If Osibanjo become president which difference e go make when him na Tinubu puppet. If Osibanjo be president mean say Tinubu na still President the way una carry that Buhari Kyari for head like say na him be president.

Las Las una never still see say that Buhari guy una dey insult anyhow be dey actually calm Buhari down because since him die Buhari come dey too brutal.

Una no dey ever learn anything at all for naija
MiztaPepperoni(m): 10:45am On Aug 19, 2021
Fahdiga:
Saraki led 8th senate is the best in history

I swear I love that man Saraki so much. The guy na real man and you dey right, na the best senate so far.
MiztaPepperoni(m): 8:29am On Aug 19, 2021
This op true true dey mad. So if my papa na president you feel say if go dey work? Which Yeye work I wan work.

That guy dey work for him papa as special adviser on family affairs. That one alone na office for the presidential villa so abeg free the guy make you go find your own work
MiztaPepperoni(m): 10:13am On Aug 16, 2021
EmekaA125:

E no concern you. Leave it for us like that. The Sit-At-Home holds.

E get one market for ariaaria I hear say them dey sell brain for there. Make una try buy if e go change una life.

How person wey dey chill abroad go order sit at home and una go dey follow follow for dirty environment when him dey chop burger with una donations. Shame suppose dey catch una sha but I don obverse say shame no even dey una body.
MiztaPepperoni(m): 9:46am On Aug 16, 2021
My only problem be say after all the noise them dey make about too much money just see how dirty their environment looks. Na true tham be real ipigs because this environment na for pigs

2 Likes

MiztaPepperoni(m): 8:28pm On Aug 13, 2021
Chronicgenius:


Lol grin

Although Barbados isn't really doing well economically...

It's a great place for vacation...

Vacation nor be permanent migration na grin

No be only vacation
MiztaPepperoni(m): 6:15pm On Aug 13, 2021
Shey Rihana na American citizen. Person japa from her country go America go hammer you come dey advice Nigerians to go there for holiday because of free visa.

6 Likes

MiztaPepperoni(m): 10:59am On Aug 13, 2021
Abeg how many guys go concur with this picture below?

Guy go dey reason how to make money feed him family but the woman go dey reason another thing.

I be dey try use my calculator take calculate that room Mecci dey stay for per night on a two years contract, my calculator no fit give the figure complete.

This life no balance ooo

1 Like

MiztaPepperoni(m): 12:38pm On Aug 11, 2021
Make una still try buy sense dey use Abeg. How human being go just dey reason like animal everytime.
MiztaPepperoni(m): 12:30pm On Jul 31, 2021
Have you used this product for your car?

MiztaPepperoni(m): 1:28pm On Jul 27, 2021
The owner no get problem because even the goat na food. If the goat finish the fool na just the slaughter the goat put am back inside the pot

4 Likes 2 Shares

MiztaPepperoni(m): 1:04pm On Jul 27, 2021
see as country fresh

1 Like

MiztaPepperoni(m): 12:25pm On Jul 27, 2021
Omo I hear say Buhari carry the key of MNK cage for zoo go London go ask UK government if the monkey wey them catch for Kenya na UK breed.

2 Likes 1 Share

MiztaPepperoni(m): 6:06pm On Jul 22, 2021
Buckeyemedia1:
Bailable offense, after which he will be deported back to his home country, or maybe he will seek asylum in Republic du Benin prison?

No mind that werey wey no sabi anything. Shey them go bail am come give am back the port make him use travel go abi
MiztaPepperoni(m): 5:52pm On Jul 22, 2021
My people this news na strong one oooo.

I just dey get confirmed info from my intelligence unit for Cotonou say this Mr Sunday don enter one chance.

Right now the matter don wear agbada because na serious offense to carry fake port for Benin Republic and if Mr Sunday dey guilty him go face the full rot of the law wey e be say him fit go prison up to 20years if care is not taken.

Now for this matter, him go need to decide whether to spend up to 20years for Benin Republic prison or make them carry back to naija wey be say him fit just dey collect small beating from dss and dey chop watery beans at least with hope say after 2023 the new president fit release am.

No be small matter oooo

7 Likes 6 Shares

MiztaPepperoni(m): 9:32am On Jul 22, 2021
princemillla:




You
Are only displaying ur hatred towards the man.

You don’t need port to get to Benin republic just le ticket. Which can be gotten for less than 1500. So let’s see what plays out with the issue of fake ports

No dey display your ignorance.

Yes person no need port to enter Benin Republic but na very big offense to go forge Benin Republic port dey use. No be even just Benin Republic, try go do fake naija port make them catch you then you go know say na offense for naija as well.

If them really find am guilty for using fake Benin Republic port then him go enter prison there because them no dey joke with that matter for there especially as them know say na naija man him be.

1 Like

MiztaPepperoni(m): 8:17pm On Jul 21, 2021
How this news take concern politics both home and abroad
MiztaPepperoni(m): 7:58pm On Jul 21, 2021
bolaayenimo:
Benin Republic should be careful of war . Yorubas are plenty there

Which war?

You think say Benin Republic people no get respect for their police and government like naija people?
MiztaPepperoni(m): 7:40pm On Jul 21, 2021
Mumu post.

Them tell you say them wan army?

You know how many of them FG dey train for university both home and abroad?

2 Likes 1 Share

MiztaPepperoni(m): 9:25am On Jul 21, 2021
Person wey them catch with fake port (Benin Republic port for that matter) una think say all these him lawyers get mouth.

Even if them no carry am back to naija (which dey very impossible) him go stay prison wella for Cotonou because of the fake port them catch am with. Him no be Benin Republic citizen so the first major question na how him take get their port to use travel.
MiztaPepperoni(m): 8:48am On Jul 21, 2021
This Igboho abi Wethin be that him name no just get sense at all. Him go country wey Buhari boy be ambassador.

All this activist and their low level of thinking dey tire me already

7 Likes

MiztaPepperoni(m): 10:02am On Jul 20, 2021
Penguin2:


Can you arrest an American in a third country no matter he caused to Nigeria?

If an American person dey carry drugs come naija steady and the Nigerian government catch am come arrest am, you think say American government fit come talk anyhow because na American citizen?

Make una dey use una head abeg.

1 Like 1 Share

MiztaPepperoni(m): 6:51pm On Jul 19, 2021
So e dey hard to see other qualified Nigerians from other part of the country for top positions if no be north one way or the other

2 Likes

MiztaPepperoni(m): 10:12am On Jul 19, 2021
Make una stop all this nonsense talk at least reason well for once.

If MNK be British citizen then wethin concern am to dey insult Nigerian government anyhow. Him dey UK dey insult naija government anyhow, dey form security for naija and dey cause death for innocent people.

Even if na American citizen go dey insult UK government anyhow come dey cause problems for UK una feel say the UK government no go catch that person put for prison?

As long as say him dey commit crimes for naija even if him be British citizen, the naija government get right to catch and arrest am anyhow even if na to catch am like animal.

Him go definitely answer for him crime especially say him go prove to us say na Jubril of Sudan order him arrest and not Buhari

3 Likes

MiztaPepperoni(m): 10:31am On Jul 16, 2021
Them laugh me say I don dey old and I no wan marry get family.

I don tire for too much marriage talk so I don decide to marry.

Abeg I dey manage one small room for face me I face you house. I no get better work but I dey hustle anyhow. I don safe 250k and I wan ask una if this money reach to do both traditional and white wedding?

I know say e go shock!!!!

3 Likes

MiztaPepperoni(m): 9:48pm On Jul 09, 2021
Wethin dey baffle me for these ipigs be say those wey dey the so called zoo just dey loyal for their ogas wey dey chill and enjoy life abroad.

Imagine biafra president go be UK citizen and vice president go be Finland citizen.

(1) (6) (of 6 pages)

(Go Up)

Sections: How To . 42
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or s on Nairaland.