NewStats: 3,263,621 , 8,180,784 topics. Date: Friday, 06 June 2025 at 08:54 PM l6w3a6z3e3g |
(1) (10) (of 163 pages)
![]() |
BTroMax: Na so. Abeg helep me. Make we dey loud am because if to say dem been loud am for me, I for don sabi this business wella. Dem no know say 0.01 lotsize for standard na 0.1 dollar(10 cents) per pip but 0.01 lotsize for cent na 0.1 cent. How you wan take blow ya $10 ?. I go dey trade am like this dey go until my enter $1k dols. ![]() You no lie. E dey build confidence. You go dey see 1000 USC ya mind go dey imagine say na 1k dols but na $10 be dat o. I like am like dat. 3 Likes |
![]() |
Omo since I start dey manage cent to blow come hard. You know say you fit trade even if ya na $1. Chai dis one na correct game changer for me. I for say make efribody open cent but una go come misunderstand me fah. Una fit dey call me Cent Papo.Na now forest start. 5 Likes 1 Share |
![]() |
BTroMax: You fit still tell us which one be block. 2 Likes |
![]() |
BTroMax: Dat one dey. |
![]() |
Make you try discover a very good money making business before you clock 20 years and try marry before 30 years. No believe say after school you go get employment. E get why. 2 Likes 1 Share |
![]() |
Which prop dey accept direct crypto transfer?
|
![]() |
LincolnOnyeabor: How you take link ya coinbase to confirmo abi you block ip? |
![]() |
If to say na just to transfer from any crypto to Goat funded. I for don run am nah. This one dรญa challenge na $17
|
![]() |
LincolnOnyeabor: Baba dรญa crypto dey link to confirmo. I been wan with confirmo. Na so dem tell me say Nigerians no get level. Abeg helep me. Show me way. |
![]() |
LincolnOnyeabor: How you take fund? Dรญa korapay no get transfer. I wish say another better prop go challenge Tentrade make dรญa mind for dey. Very anyhow people wey pay promoters #25 metres come wan use Nigerians recover. 2 Likes |
![]() |
Abeg I need cheap prop to buy. Which prop firm get cheap legit challenge? Mention the ones wey dey pay you steady abeg. |
![]() |
BTroMax: Abeg how dem go run am? Dem get virtual MasterCard? |
![]() |
RISQUE: Lol. Who dem fit chance for that list? Dem try even get conference because na relegation dem suppose dey. 3 Likes |
![]() |
Who don use grey here? Like this I wan try am. Everywhere good? |
![]() |
seeteazain: Baba even if dem no dey give anything. Try run am sha. |
![]() |
Sonnobax15: Odogwu Parana(Love in every word and A tribe called Judah) movies I don watch so no bad. I nobi Nollywood fan though especially after most of our veterans don leggo. Infact to find better Nollywood watch na by recommendation. Funke Akindele dey try too. |
![]() |
peanutbutterr: If na personal you fit run am. 2% no bad. Na ya strategy and experience matter but if na prop omo I no dey o even if na you discover forest. |
![]() |
JasonNOTStatham: I get question. Abeg person fit use USDT pay for something in Euro? I dey ask because FTMO charge Euro. |
![]() |
FTMO get academy. How many people here don run course there? Omo na student I be like this o. I don enroll. The courses fa make sense. 2 Likes |
![]() |
JasonNOTStatham: Yeah the app fine the mobile site. But na Dot io for site. Dem even dey send email for activity update. |
![]() |
JasonNOTStatham: Na better update be this o. Me wey been dey fear crypto. If you get another legit site like that you fit still drop am. Na so crypto site suppose be. Nobi only send and receive. This one you fit swap, trade, send, receive, store. Chai my body dey totori me... Thanks. |
![]() |
JasonNOTStatham: Na Dot io or na Dot com? |
![]() |
Banat89: Chai dem go don dey miss my babe Oshoala by now. No tell me say her goals for no matter because that one na lie. |
![]() |
randy01: On top the rules na only 7% of ya you fit withdraw even if you make 50% profits. Na that one nobody wan talk here. I no mention say ya challenge money no dey refundable. 2 Likes |
![]() |
randy01: Bro nobi say the rules too complicate o. Because you go don calculate am know whether na 100 pip or so you go dey target. You go need like 6 to 10 trade to am if losses enter. Na the forced lot be the main Koko. Dem go force you trade 0.05 minimum on top $3k . If you blow 100pip 5 times otilor unless na the $1k instant be 0.01, you go need blow 100pip 9 times but if you reduce am to 60 or 70 pips you fit get like 12.. chance. I hope say dem go last make you see withdrawal collect. Las las no buy prop if you no get better strategy. 2 Likes |
![]() |
LincolnOnyeabor: Even if you be guru, say market nobi ya mate. Na on top $18 you knack 0.03 lot?Na even almost same position you open am. Come still talk say na investor money? So person give you $1000 na so you wan run am? Hmm. This one na gamble. Because any mistake that money go enter Forest. Na why you go hear story like I flip $25 to $300 but I come blow am. 7 Likes |
![]() |
randy01: No wahala. But you need open a cent make the money fit last for you. Let's say you deposit $15, dem go convert am to 1500 cents for you. If you come knack 0.01 lot for cent , 100pip go be 100cents or $1. You see say your go last? But I hope say you get good strategy o. say nobi must to trade everyday. 2 Likes |
![]() |
randy01: Ya highest profit in a trade over the total profits in percentage no suppose the profit score. Example If profit score na 25% You buy $3000 hoping say you suppose make 10% to evaluation.($300) Ya highest daily profit come be $60 ie highest amount you make for one trade So $60/$300 ร 100 20% na ya profit score. E dey below 25% nothing does you. But if e 25% you go continue dey trade until e reduce. You go still work am before you go withdraw otherwise you go start again from beginning. |
![]() |
Bowwow11: Nobi because of 2k Sha na the slapping cause am. If younger brother slap senior brother wife naim mean say he no rate the senior brother at all. But nobi wetin go make am kpai him blood. Normal beating suppose dey alright unless dem don get bad blood or beef taytay. 1 Like |
![]() |
My question be say na who come lose for this matter on top #2000?
|
![]() |
JasonNOTStatham: You fit store, buy and sell your crypto and dem fit pay you in naira to your bank ? How long you don dey use them? |
![]() |
LincolnOnyeabor: I no know wetin happen and I no wan know until market close but as e take be gold technically dey bearish but fundamental come dey reason bull. As e be all man suppose rest as gold vomit over 900 pips from Tuesday to Wednesday. For Ten trade their profit score fit no allow you to chest am. Na like 300pips or 400pips na why I tire. |
(1) (10) (of 163 pages)
(Go Up)
Sections: How To . 40 Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or s on Nairaland. |