NewStats: 3,261,800 , 8,175,196 topics. Date: Friday, 30 May 2025 at 03:26 PM 73255x6z3e3g |
Guys Help Have Been Put To Shame Again Oooooo(pics). (6014 Views)
(1) Go Down)
Iamdbull: 4:28pm On Aug 06, 2021 |
So after spending some quality time at the gym building muscle wey no show( e be like say my village people dey thief my muscle with all my gyming I still be like turkey) and also doing calculation or SAPAculation as the case may be, I decide say na once man dey die, make I carry the little change wey remain for my savings ( as una all Sabi say I don carry all my money go do music wey no blow instead of my music to blow na so so shame e dey bring upon me I don suffer) go chop fried rice and chicken for one nice eatery. Na so I sit-down jeje dey reason how the 1900 wey I take chop don sink hole in pocket na so two beautiful tall sexy looking ladies waka inside the eatery with fliers, it's obvious they came for marketing. Na so I sit-down jeje dey watch as them they to people. That's how them reach my side ooo to my biggest suprise na so them Waka !!! go meet another person wey dey behind me na so them comot ooo. The thing do me gbirigbiri for body say wetin Dem dey wey no dey befitting for me? Out of busybody na so I go the table of some customers wey just comot check the flier see wetin dey their na so I see say na car Dem dey kpolowo. Na so I go the eatery mirror wey dey the wash hand basin look my sef from my empty coconut head to my toes. I come confuse dey ask myself say "I no resemble person wey fit afford car" chaiii and this morning I dey hail myself say I don dey fresh ooo So my dear ladies and gentlemen as body dey hot me I say make I take pictures so as to help me analyse am and answer this question DO I REALLY LOOK SAPALISTIC ? 11 Likes 3 Shares |
YeyeGbami: 4:31pm On Aug 06, 2021 |
They fit assume say you drive come, maybe you carry key for hand. ![]() 5 Likes 1 Share |
Godada(m): 6:08pm On Aug 06, 2021 |
Them don see your six pack. Them conclude say you nor get dough 3 Likes |
Aniboo: 6:12pm On Aug 06, 2021 |
Na you sing these songs?
4 Likes |
KingDash: 6:17pm On Aug 06, 2021 |
Aniboo:the guy talent no reach that side. 12 Likes |
MufasaLion: 6:40pm On Aug 06, 2021 |
You no look attractive to them ![]() |
Ayo2004: 6:56pm On Aug 06, 2021 |
This guy be like woman He too like clout ![]() 7 Likes |
Lucrativress(f): 7:10pm On Aug 06, 2021 |
Iamdbull:Your choice of colour and your demeanor I guess. If you want to look it,then feign it, court attention with every detail in you. ![]() ![]() Now imagine wearing brighter colours with a pretty indifferent look on your face,then just a little spocky look to your brows A bright colored Durag With bright colored clothes sha on maybe bright colored Crocks ,a gold wristwatch. This is going with your Entertainment stuff ![]() Then pay no heed to any other person in the room but yourself, the attention will come to you ![]() A carton colour leather Wallet then your House keys on the Table to give the illusion of "Car Key's" Glance at your wristwatch every 20mins. ![]() 13 Likes 2 Shares |
Cerebellum: 7:13pm On Aug 06, 2021 |
Lucrativress: Oyar modify that plenty quote ![]() Now back to OP...Your mumu never do ![]() 1 Like |
Lucrativress(f): 7:20pm On Aug 06, 2021 |
Cerebellum:Better lemme o I don add to am sef OP fake it till you make it o Dress extravagant and classy to deals Be pretty calm,conceal your irations, try to only talk when pretty necessary,look into people's eyes when talking to portray confidence,when trying to make a deal,go above your pricing a bit,be cool,be pretty cool so they feel you worth it. The attention will find you ![]() 2 Likes |
Cerebellum: 7:24pm On Aug 06, 2021 |
Lucrativress: I won't leave you..oyar come back here ![]() |
Lucrativress(f): 7:35pm On Aug 06, 2021 |
Iamdbull:I could give you more practical coachings if you want. All I want in exchange is free front seat for your Shows when you blow and free selfies with you. Wait, before you think of turning me down, I'm quite vast in music, I've not listened to your Songs yet but being acquainted with you would be a good thing,I'm pretty lyrical.. ![]() |
Lucrativress(f): 7:37pm On Aug 06, 2021 |
Cerebellum: 7:42pm On Aug 06, 2021 |
1 Like |
traihit: 7:48pm On Aug 06, 2021 |
Iamdbull: I believe that if you visit mental gymns more than physical gymns, 'Sapalism' will become more automatic to you than this level. 1 Like |
Freebandz365: 8:09pm On Aug 06, 2021 |
Good evening nairalanders I sell Airtel and MTN data at affordable rate 1k=4gb 2k=10gb Validity=30 days Please patronize me. WhatsApp number 08082077444 Thanks and God bless |
Re: Guys Help Have Been Put To Shame Again Oooooo(pics). by Nobody: 8:31pm On Aug 06, 2021 |
. chai! you really look sapalisticated!! buhari no go shame us in this corn-tree sha! ... .. |
Iamdbull: 8:52pm On Aug 06, 2021 |
Lucrativress:Wow Hit me up Zero70655ten399 Thanks 1 Like |
unamamatoto: 9:41pm On Aug 06, 2021 |
Cerebellum:Ode Simp ![]() 2 Likes |
Cerebellum: 12:06am On Aug 07, 2021 |
unamamatoto: He he Lol...me simp ![]() ![]() |
The5DME(m): 12:17am On Aug 07, 2021 |
[[s]quote author=Lucrativress post=104502837] Better lemme o I don add to am sef OP fake it till you make it o Dress extravagant and classy to deals Be pretty calm,conceal your irations, try to only talk when pretty necessary,look into people's eyes when talking to portray confidence,when trying to make a deal,go above your pricing a bit,be cool,be pretty cool so they feel you worth it. The attention will find you ![]() |
The5DME(m): 12:18am On Aug 07, 2021 |
Iamdbull:keep using your alternate moniker to quote yourself. |
ibelieveinjesus: 1:24am On Aug 07, 2021 |
This is Electrifying. Dude is so lit. An inspiring one minute spoken words poetry on Education. L.A at his best. https://www.youtube.com/watch?v=zPE2cJIJY4A who go help you bayi ![]() |
ibelieveinjesus: 1:25am On Aug 07, 2021 |
who go help you bayi This is Electrifying. Dude is so lit. An inspiring one minute spoken words poetry on Education. L.A at his best. https://www.youtube.com/watch?v=zPE2cJIJY4A this leaves me speechless |
Re: Guys Help Have Been Put To Shame Again Oooooo(pics). by Nobody: 6:45am On Aug 07, 2021 |
The same Bull again?
1 Like |
AgentGoat: 7:07am On Aug 07, 2021 |
2 Likes |
Truvelisback(m): 8:11am On Aug 07, 2021 |
You look sufferlistic ![]() 1 Like |
Xbursta(m): 9:05am On Aug 07, 2021 |
Lucrativress: All these gramer just tell am you like am make una relate well 2 Likes |
Iamdbull: 3:00pm On Aug 07, 2021 |
MufasaLion:Chaiii |
Lucrativress(f): 3:14pm On Aug 07, 2021 |
Iamdbull:Wait wait lemme Goan scream!!! Iamdbull gave me his number aaaaaahhhhhh ![]() Free front seat loading no matter the amount of the Show aaaaaaaaaaaaaaaaaaahhhhhhhh Wuahhhhhhhh!! Oyaaaaaaaaa ghennnn ghennnnnnnn 1 Like |