NewStats: 3,263,446 , 8,180,169 topics. Date: Thursday, 05 June 2025 at 11:45 PM 3b4i6m

6z3e3g

Ibrahimovic303's Posts 1kwt

Ibrahimovic303's Posts

(14) (of 26 pages)

ibrahimovic303: 7:17am On May 01, 2019
Hadampson:
Keep the pictures coming boss smiley

Been plan to travel to 5 countries within Schengen cos of my football hustle but it got delayed if not una for tire sef, but will definitely go later this summer smiley

4 Likes 1 Share

ibrahimovic303: 7:16am On May 01, 2019
hustleranthem:
The location soft anyhow..

Yeah
ibrahimovic303: 8:12pm On Apr 30, 2019
Time now na 22.11 oh and e just clear like kilode undecided I nor dey fit sleep well for summers/springs cos the sun nor dey quick go down and e dey quick rise lasan...to 4 for morning sun don fallout sha undecided

7 Likes

ibrahimovic303: 8:03pm On Apr 30, 2019
As Finno guys high them go start to speak English grin...Their highness na trips trust me cheesy

8 Likes

ibrahimovic303: 6:58pm On Apr 30, 2019
Booze...pizza...cigarettes...wetin man go do ni undecided

8 Likes

ibrahimovic303: 6:32pm On Apr 30, 2019
Long and short, na the istrative buildings for the University be this, I think private entrepreneurs get blocks around here too from my observation

7 Likes

ibrahimovic303: 6:28pm On Apr 30, 2019
Lol i try zoom to observe this crazy lad grin

8 Likes

ibrahimovic303: 6:22pm On Apr 30, 2019
One of the student hostels...lol my guy hand don show grin

8 Likes

ibrahimovic303: 6:21pm On Apr 30, 2019
Observe am well cheesy

8 Likes

ibrahimovic303: 6:20pm On Apr 30, 2019
Omor na so I just see myself for Seinäjoki today oh, tomorrow na public holiday normally, came for a party in this town...these views na Seinäjoki University students wey dey flex grin na the views of the campus and hostels...One crazy Finnish guy jumped into the stream naked grin

7 Likes

ibrahimovic303: 6:17pm On Apr 30, 2019
IchBinBrait:
Nice pictures Mr Ibra.. Mehnn see how clean the surroundings are. You don't wanna show us the interior of your house grin

Please do change your car tyres asap.

That one nor be wahala..! Lol.. grin well my Estonian friend been help me change am for free, i sha buy am pack of Karhu (a Finnish beer) grin in return

1 Like

ibrahimovic303: 2:29pm On Apr 28, 2019
Hadampson:


Children nko or the 3 cats na her children cheesy

No her kids are all grown men
ibrahimovic303: 2:12pm On Apr 28, 2019
Hadampson:


Yeah.. I'm getting addicted to it already cheesy

I no dey go gym house. Na for house i dey do my exercise smiley

E make sense lasan
ibrahimovic303: 2:11pm On Apr 28, 2019
Hadampson:



I believe so but this block ehn na hin dey prevent me from going to my country cry






Wow.. That's cool boss

I plan on applying for a delivery job in foodora cos of my laps. I wan build am cheesy


Yeah but small time you go prefer to use car na...bicycles dey sweet to ride during summer/spring like this, nor be when you dey see -20 and snow everywhere, the riding go tire you sef grin

2 Likes

ibrahimovic303: 2:09pm On Apr 28, 2019
Hadampson:


Lol... Be like say majority of them no dey gbadun winter at all

I dey tell you...majority prefer summer, actually many Finns live and work in warmer EU countries like Spain, Turkey etc during winters and move back here during the summer...I know a Finnish lady that would retire soon who plans to use her savings to open a restaurant in Madrid and move there with her hubby and 3 cats as kids are all grown up sad
ibrahimovic303: 2:02pm On Apr 28, 2019
Hadampson:


Hmm.. Okay boss
I will continue with the exercise routine then... 6 abs is a goal this year smiley

You go see say after some months ehnn, the thing go come dey sweet you sef, you will become addicted to going to the gym or exercising grin

2 Likes

ibrahimovic303: 1:59pm On Apr 28, 2019
Hadampson:


I always make research about and other countries boss. Stumbled on it while i was checking something out on a forum smiley

That ability go help you wella on your own when you arrive Germo, trust me...Foodora dey Tampere and Helsinki, for this my city, Vaasa, na Wolt dey here

2 Likes

ibrahimovic303: 1:56pm On Apr 28, 2019
Omor na once Finland turn Naija oh... Perfect weather to enjoy...Finns dey always dey livelier during the summer as sun dey nack them wella grin...then winter them go return back to default settings undecided

6 Likes

ibrahimovic303: 1:56pm On Apr 28, 2019
Omor na once Finland turn Naija oh... Perfect weather to enjoy...Finns dey always dey livelier during the summer as sun dey touch them well...winter them go return back to default settings undecided

5 Likes

ibrahimovic303: 1:49pm On Apr 28, 2019
Hadampson:




Na so boss but no dey easy o cos whenever i start abs beginner exercise, i usually feel very hungry plus those abs dey pain me somehow embarassed


Seriously that’s how it is in the beginning, as I dey talk to you I be gym rat now sef, if I nor go gym one day e go be like say I don miss one big money wey dem share grin so no pain, no gain...the hard way, the only way!

1 Like

ibrahimovic303: 1:47pm On Apr 28, 2019
Hadampson:


Is it foodora you are talking about??

Cos i learnt they have many branches in Europe and North America

Yes! Foodora....! How did you know about them? Wow you’re very knowledgeable...wow

2 Likes

ibrahimovic303: 1:31pm On Apr 28, 2019
aodiba:


You are studying one of the courses I refer to as fine courses... With perseverance and hard work there are opportunities. Don't just limit yourself to getting job in Finland or Norway...
Great thread SIR Ibrahimovic303... Been following from the beginning
Shalom

Thanks
ibrahimovic303: 1:31pm On Apr 28, 2019
Hadampson:


Good one boss

First thing wey i go smiley

Boss, my abs don reach 3... Slowly but surely, am getting there wink

Correct...! Na small small

1 Like

ibrahimovic303: 1:30pm On Apr 28, 2019
Hadampson:


That one no be problem for me.

I see RIDING BICYCLE as a form of exercise.

Yes of course na exercise, but for Scandinavia sef na means of transportation too, especially in the beginning of your hustle here...some food companies even pay you per hour to use your bicycle to deliver food within your city

1 Like

ibrahimovic303: 1:28pm On Apr 28, 2019
Hadampson:



Lol.. Just dey enjoy boss.. Nothing do you smiley

Omor wetin man go do now..? smiley

1 Like

ibrahimovic303: 5:24am On Apr 28, 2019
drakura:
Boss @Ibrahimovic303

Been following you since last year you created this thread, thanks for the updates

I plan to come Finland or Norway to do my masters in International relations or Diplomacy, pls is there any career opportunity for people in my discipline at all over there?

Well of choice there are always decent career opportunities in that field, but like always, it depends on so many factors; language skills, work experience, your own networking skills too will come into play...If I tell you that it is easy to get a professional job in these countries I would be lying...but then lots of Nigerians and Africans have grown through these systems through hardwork, perseverance and of course, grace...so why can’t you and me do same? wink

4 Likes

ibrahimovic303: 2:52pm On Apr 27, 2019
Adeniyii2017:

Like how much does it cost you per month and how often can you visit??
Nice thread!

I pay usually €40/month...it is this expensive because Vaasa is a big city sort of....and I can gym anytime, no matter the number of times
ibrahimovic303: 1:24pm On Apr 27, 2019
hustleranthem:
it's like people no dey use the gym very often there

People dey use am wella oh, but me i target when traffic nor go dey there so i fit use the equipments to my satisfaction... smiley
ibrahimovic303: 11:56am On Apr 27, 2019
hustleranthem:
notin do u baba. Ride on to Galilee lol

Lol abi.. grin
ibrahimovic303: 9:20am On Apr 27, 2019
Make i go house go chill...Make una drop comments make we relate wella today, later this evening I gaz go change my winter wheels to summer wheels for my car before police go fine me €200 again... undecided

9 Likes

ibrahimovic303: 9:18am On Apr 27, 2019
Hope say una wey dey plan come here sabi ride bicycle? angry Trust me na this bicycle I use take hustle for some months till I gather small change buy my car...so if you nor sabi ride, better change to America cos you nor go escape am for Europe sef grin or you go riding school for Oshodi cheesy...

11 Likes

ibrahimovic303: 9:11am On Apr 27, 2019
Gym things oh....man gaz dey fired up for the summer...na summer immigrants like us dey fit hustle wella and make more than enough money las las smiley

9 Likes

(14) (of 26 pages)

(Go Up)

Sections: How To . 29
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or s on Nairaland.