NewStats: 3,259,652 , 8,170,648 topics. Date: Sunday, 25 May 2025 at 06:11 PM 1t4f3n6z3e3g |
Proverbs From The Streets Of Warri (46897 Views)
Conceptman: 4:02pm On Dec 21, 2019 |
Warri!!!
1 Like |
KingGBsky(m): 4:03pm On Dec 21, 2019 |
Midjulss: How this one take be parable? 8 Likes |
Re: Proverbs From The Streets Of Warri by Nobody: 4:03pm On Dec 21, 2019 |
You be my brother no be for mouth... Abeg show love
6 Likes |
msmon(m): 4:04pm On Dec 21, 2019 |
Rapmoney: Mad Ooo |
tonbratom(m): 4:04pm On Dec 21, 2019 |
Pikin wey dem carry for back say e match bottle.. Person wey never start business say gain wun kill am. Ashawo mama die, in-law nur dey. Na cooperation dey make rice full pot. Rice wey dey buttom of cooler today go dey on top tomorrow. Toto water small normally, but prick must baff belleful. Na i go do am later nai make fowl nur fly like other birds. 16 Likes |
Obakoolex(m): 4:06pm On Dec 21, 2019 |
If your noodles done fast fast No mean say my beans no go soft last last 12 Likes 1 Share |
Wronggee(m): 4:09pm On Dec 21, 2019 |
dem left ear quote author=Dozie32 post=85105849]Warri!! Their fada!!! [/quote]
|
DICKstractor: 4:09pm On Dec 21, 2019 |
On seeing "WARRI proverb", I rushed to screenshot without reading first. I thought the proverb will literarily blow my mind but it literally did the opposite... . . What am I even saying 1 Like |
mu2sa2: 4:14pm On Dec 21, 2019 |
Malawian:Hahaha! 5 Likes |
saraki2019(m): 4:15pm On Dec 21, 2019 |
Life is like dick only woman go make am hard or sweet
2 Likes |
Sammyblack87: 4:18pm On Dec 21, 2019 |
Person wey no no book, he say get handwriting
4 Likes |
blackfish56: 4:19pm On Dec 21, 2019 |
E nr dae e nr dae Who naked nor dae put hand 4 pocket 2 Likes |
blackfish56: 4:20pm On Dec 21, 2019 |
If lion na barber for goat community make all the goat ready train afro
9 Likes |
guass(m): 4:21pm On Dec 21, 2019 |
Make I still add as Warri pikin. WARRI_PROVERBS 1. Na person wey never see problem dey use English dey pray. 2. Book wey no gree enter head go enta exam hall 3. Goat wen get mind follow lion go catch fish, make e know say weda dem catch fish or not, Lion food don set oh. 4.who naked no dey chuck hand for pocket...! 5. wetin concern dog wit family planning?.. 6.Na determination dey make Okada overtake trailer for road. 7. This one good, this one good na em mad man take dey gather plenty load. 8.Pikin wey go strong go strong.... No be say until dem name am Samson. 9.Na over confidence make February no complete. 10. Do you know who I am? Do you know who I am?..Naso hold up take dey start. 11.Head wey no wan think go carry load.. 12. Hand wey stay long for pocket, know say nothing de that pocket. 13. Forget Trust If trust dey, Water nor for boil Fish. 16.No matter how lizard do press-up reach, e no fit get muscle crocodile . 17. E de clear pimple, e de clear pimple na so bleaching de start. 18. Feel at home, feel at home na eim dae make visitor spoil remote 19. Escort me, escort me naso slave trade take start. 20. It's a small world!! No mean say you fit trek from Naija go London. 21. Christianity is free, but you must buy Bible 22. Person nor dey use shame chop winch o 23.Make I chop this guy money, Make I Chop this guy money. Na so ashawo take start oh. 24. You no need spoon and cutlery to chop slap. 25. Jollof Rice wey dey for bottom of pot 2day go dey for top of cooler 2moro. 26. The patient dog ... Nah hungry go kill am. 27. Na I go do am later na e make fowl no fly like other birds. 28. No food for lazy man no be for pesin wey em mama get restaurants. 29. Who dey hold landlord rentage no dey fry stew way curry dey. 30. I am covered by the blood of JESUS E no mean say make u no lock door sleep oooh 31.) Pastor wey dey pray for mad person no dey Close eye. 32.) I need pikin, I nepost ikin, na e make woman no wear pant sleep. 33.) I know too much, i know too much na e make SAN no fit recite National Anthem. 34.) This write up good, this write up good, na e make me (the writer) no come know how to count 1,2,3 again. 35.) The tin wey make egg strong for port nai make yam also soft for port 36.) Pikin way Say e mama no sleep, he self no go sleep. 37.) Sun 2 hot e nor mean say fowl go Lane boiled egg. 38.) Monkey smart monkey smart, nah because tree near tree 39.) Na run wey nor serious, Na in woman de hold breast. 40.) Na cooperation dey make rice full pot 41.) Cockroach wey say him sabi acrobatic dance where cocks are doing general meeting don waka kurukere waka 42.) Say Lion dey sick, no mean say him wit cat na mate. 43.) This burial rich, this burial rich, na e make to die hungry elders. 44.) Had it been, there is an atom of truth in tortoise, e for don kiss person. 45.) Na economy recession make teacher use ruler measure yam. 46.) Pikin wen wan chop party rice, e no dey fear dance!!! 47.) Say cat sabi swim no make am catfish. 48.) E go beta, e go beta, na e make camel still dey cari load. 49.) I no be your mate. na e make slippers get size 50.) This boy fine, this boy fine na so she open leg for 37 boys 51.) Fish wen scatter for soup still dey inside the soup. 47 Likes 6 Shares |
Electricals: 4:22pm On Dec 21, 2019 |
So every pidgin English proverbs don turn to Warri's proverbs? Warri people no get language again? |
Kingnelson9: 4:28pm On Dec 21, 2019 |
nawao to you o..dem no dey tell deaf and dumb person sey war don start
|
nachinaGod: 4:29pm On Dec 21, 2019 |
Pesin no dey use ordinary eyes go worship for cherubim and seraphim
2 Likes |
Kingnelson9: 4:30pm On Dec 21, 2019 |
use ur head use ur head no mean sey u go back ur head for wall
|
OTayobami(m): 4:30pm On Dec 21, 2019 |
Wetin musa nor go see for gate
1 Share |
Rapmoney(m): 4:35pm On Dec 21, 2019 |
Electricals:Who come be dis one? ![]() 2 Likes |
shaibudauda: 4:40pm On Dec 21, 2019 |
Small pikin wey dem carry for back no know say the journey far. ![]() 3 Likes |
sharone21(f): 4:42pm On Dec 21, 2019 |
Truth be say, whether na Warri, Ijaw, Anioma etc, ALL Delta na ONE especially for sense and ancestry.
1 Like 1 Share |
Princerichi0(m): 5:06pm On Dec 21, 2019 |
Erigga Who wahala naked follow no dey use English pray |
doctore212(m): 5:08pm On Dec 21, 2019 |
![]() ![]() ![]() Davash222: |
Koboko2580: 5:09pm On Dec 21, 2019 |
sew below
|
NiklauseFred(m): 5:13pm On Dec 21, 2019 |
Pikin wey see breast suck na em dey fo nyanka o Monkey smart monkey smart na because tree near |
Jms85(m): 5:21pm On Dec 21, 2019 |
person way d eat fish go ready to swallow fish bone..
|
Jms85(m): 5:22pm On Dec 21, 2019 |
person way dey eat fish go ready to swallow fish bone..
|
TheManOfTheYear: 5:24pm On Dec 21, 2019 |
Toto water no plenty but e reach prick take baff
|
successking401(m): 5:27pm On Dec 21, 2019 |
guass: 3 Likes |
Spot This Outside Your Gate, What's Your Next Move?
(Go Up)
Sections: How To . 46 Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or s on Nairaland. |